*****DAILY DIET*****
=====EJIKE AND HIS WIFE'S PALAVA (Episode 1)=====
My people, wetin my two eyes see, I go need two mouths take talk am. But, as he come be say na only one mouth I get, na him be say I go manage use one mouth talk wetin my two eyes see. But, make we talk tru, person eyes dey see sha ooooo... Wise people don talk am say eyes wey see evil wey no blind, na him be say the eyes no go blind again. As I dey yan you so, my one and only friend dey hospital right now. Doctor don hang him two legs like branches of a tree, and dem don plaster him who body with P.O.P as if say him na house. If you visit Ejike for hospital now ehn...you go pity am and him condition. Chai ! There is God oooooo. No be accident put Ejike for the condition wey him dey oooooo. If na accident, if for no even dey nak una this story. My people, no tell anybody say I tell you oooooo. Abeg, I take God beg you. No just mention my name join this tori at all because I no want make dem hang my own legs too for hospital. (Whispering) "Na Ejike wife put am for that condition"
Hmmmmm...Me I always dey talk am say to know better wife fit hard one kind, but to know wife wey bad, he no hard at all. Na wen Ejike don dey gist me say him dey like Nneka, na him Idon dey warn am say make he no try that kind play at all. Make una self imagine. My friend, Ejike no get body at all. Infact, him lean pass one of my country's president wey I no want mention him name. Now, Nneka na like 10 times of Ejike raised to power 2. Abeg, na which kind love fit grow for their side? "I love Nneka so much. She is my dream girl" My friend Ejike dey tell me that time wey him want propose to Nneka. "Dream girl kwa?" Na so I ask am oooooo...I just dey look am like plasma TV as him dey run him mouth like tap. Small time, the two of dem marry, and na me do the Best Man. I don warn Ejike say make him no try carry Nneka on their wedding day, but Ejike no gree hear oooo, and na there him wahala for start. As he dey try lift Nneka up, he just be as if say ant wan carry Elephant, and na so him wife dey shout, "honey, be a man. Carry me." Carry kwa? I even want help Ejike make the two of us try lift Nneka up from ground small, make all for no loss. "Guy, no try am ooooo... She is my wife, and I must to carry am." Na so Ejike shout give me. As he talk that one finish, the next thing wey I hear na one kind big mess wey dey tear cloth.
(c) 2016. Austus Ofmat Nwanne
Person eyes dey see some kind things sha oooooo. Just join me again tomorrow make I give you the full gist about wetin land my friend for hospital. But, for the guys in the house, no marry any girl wey big ooooo...it's for your own sake. And, for girls wey big like Nneka, I take God beg you, abeg, go find your mate. Me I don talk my own ooooo...I'll come your way again tomorrow for the concluding part of this comedy. Takie.
Did you know that nomination for the Nigeria Writer's Award is still on? Yes. It's still on, and nomination would end this Friday. So, if you have not nominated me, kindly follow the link below to nominate me. Thanks.
http://tyobstacle.blogspot.com.ng/2016/07/nominate-me-for-nigeria-writers-award.html?m=1
---------
AUSTUS OFMAT NWANNE
Inspirational Speaker/Media Consultant,
Swift24 Multimedia Services.
Whatsapp :: +2348072970850
Instagram :: austus_ofmat_nwanne
Facebook :: Ofmat Austus Nwanne
Email :: Tackleyourobstacle@gmail.com
0 comments:
Post a Comment