As Mama Okpakororo want rush the woman wey talk say, there is love in sharing husbands, na him the woman dodge am. The next thing wey we see na Mama Okpakororo for ground oooo....Na so people come dey try to help her up. As she get up finish, na him she waka meet the woman, download one kind 5.5gig slap for her face. He be like say the woman sef na Agbero daughter. She no even wait make the slap download finish, as she sef return Mama Okpakororo face to factory reset with two different 3 gig slap. Men, the downloading fast ehn... Meanwhile, Pa. Okpakororo don dey near the pastor. "You see wetin you cause?" Na so Pa. Okpakororo dey talk as he dey near the pastor. "Touch not my annointed..." Pastor dey yan Pa. Okpakororo dat Bible verse. As if say the mara pass the little mistake wey pastor make. As Pa. Okpakororo dey near pastor, na him pastor bring out one small pistol from him suit. Na him everybody give pastor Ebola distance. Those wey don run don run. "I say touch not my annointed..." Pastor shout again. Me I no know the kind liver wey Pa. Okpakororo chop o. Him no even shake as him see the pistol. Him still dey waka near pastor. Maybe him believe say pastor na M.O.G, and M.O.G no go fit kill person. My people, before we know, one spanner fall down for that place o. Na the sound of the gun make the woman stop, as she be dey install some software for Mama Okpakororo face. Before we know wetin happen, everybody don vamoose. If be say Mr. Death-no-fit know, only him one for just waka come bury himself. Chai !!! Daris God oooooo.....
Well, if you didn't laugh, no problem with that. But, atleast, you smiled. That one self follow. Please, bear in mind that parents don't attend the funeral of their children. I only used it in this story for the sake of JOKE and COMEDY. Join me tomorrow as I would be starting a new mind-blowing, suspense-filled and lesson-filled story. I'm sure you don't want to miss it. If you would like to always receive Daily Diet on your phone via Whatsapp or you have a friend you'll want us to add his/her number to our broadcast list, kindly send a message to +2348072970850. Also, read up all my past articles on my blog @ www.tyobstacle.blogspot.com
HAPPY TUESDAY !!!
-----
AUSTUS OFMAT NWANNE (Mr. Tackle)
Inspirational Speaker and Business Consultant,
TYO Konsult Services.
+2348072970850 (Calls and Whatsapp)
Tackleyourobstacle@gmail.com
0 comments:
Post a Comment